More blessings for Nollywood actress, Funke Akindele, aka Jenifa, as RB Nigeria, wey dey make Dettol soap and oda Dettol products, don arrange endorsement deal for di actress, wey God just bless with ejima, not long ago. We nor sure how mush alert di deal land for Funke bank account, but gist for some background, dey claim say di deal, make Funke account add weight, base on se di money loooooong. RB Nigeria, unveil Funke today Wednesday for Radisson Blu Hotel, Ikeja Lagos, as dem launsh dia new “Dettol Clean Naija” campaign, wey dem wan use take encourage Nigerians to dey clearn up, make Naija for dey healthy.